Get Affordable Webhost

Wednesday, 30 July 2014

Ladies and Gentlemen dis na d first pidgin english news update for JUB by SAPELE TAFIA

THE EBOLA VIRUS.
Dem nor dey use brokos dey try gun jazz O.
Na day time dem dey find black goat.
Prevention is beta than cure.
For this life now, ignorance nor be excuse again.
So, who get ear, make e hear.
Ebola disease na sicknes wey Ebola virus dey cause for human being body .............
This sickness so get many signs wey go dey show for your body wey go make doctors reason am say may be you get the disease.

SYMPTOMS
As soon as the virus enter person body, na from the second day e go start to operate. Sometimes, e fit dey the body reach 3 weeks before e start operation.
The sign go start with fever, throat pain, joint and muscle pains and headache.
Then the person go get nausea, start to purge and vomit like who get cholera,
And some people, fit get kidney failure, their liver nor go dey work well and them go dey bleed anyhow.
HOW DEM DEY CATCH THIS DISEASE?
When person wey nor get the disease come in contact with infected blood or bodily fluid of infected person or animal like monkey or fruit bat or pig or bush animal, the person fit contact the Ebola Virus Disease (EVD).
This fruit bat nai be the major spreading agent of Ebola virus as e fit dey carry the virus and spread am but e nor go dey infected by the virus.
The virus nor go kill am.
This bodily fluid include sweats, spits, sperm, cattarh, sneeze, tears and semen.
So, person fit contact Ebola disease through sex too.
This disease fit dey man body for the next two months during which, the man fit spread am if e nor know.
The best way to know whether you get Ebola Virus nor be through the symptom o.
Nor use eye gage.
Go do blood test if you dey get those symptoms for medical laboratory.
So, for the blood test, dem go first eclude the fact say you get malaria or cholera. Once dem confirm am say nor be fever or cholera dem go start to reason Ebola Virus disease.
PREVENTION
Na just to reduce contact with monkeys, fruit bats, pigs and other bush animals.
Avoid contact with person bodily fluids and blood whether e get the disease or not.
Treat everybody like suspect becos life nor get negative wey you go fit wash another copy if you don kpai.
If you get any of these animals, go veterinary clinic go test dem. If dem get the disease, just kill dem and throway dem.
Shikena.
Make sure say you take extra care in handling or cooking bush meats.
And if you dey collect sample from infected person as a medical person, take better care. Use hand gloves when you dey attend to Ebola virus patient.
This disease so, na Africa nai e for comon and dem notice am around 1976.
Dem come notice say e dey kill anyhow this year 2014. Right now for Africa, e don spread follow Guinea, Sierra Leone, Liberia and Nigeria.
Sudan nai dem for first discover Ebola Virus. Befor dem see am for Democratic Republic of Congo.
Right now, no vaccine to prevent am and no cure to stop am, so, follow up with personal hygiene to avoid had i know.
My pipo, make we dey careful o becos anything wey dem dey call virus dey bad pass time bomb.
Health na wealth.
Make we try avoid bush meats becos nai be the major source of this virus.
*Avoid hand shake.
*Avoid hugging.
*Avoid anyhow kiss.
*Avoid body touch body.
*Avoid unsafe Sex. Infact nor sex anybody outside ur spouse.
*Avoid Public places wey go lead to body contact.
*Avoid anytin possible.
ADVICE:
*E nor bad to dey wear nose mask for working place.
*E nor bad to wear skin handglove to avoid skin to skin shake.
*E nor go bad to avoid some persons wey nor dey follow instruction. etc
Who get ear make e hear.
And if you get anything to add join make we for know better, oya, drop am make God bless us.
Finally, make we pray make the grace of God cover us from any deadly disease as we dey draw ear to all married pipo now to zip up or u kpai ur family with ur hand.
HIV/AIDS don do e own.
Na Ebola Virus Disease turn now.
God forbid.
Amen.

No comments:

Post a Comment